Justin Trudeau resign: Canadian Prime Minister Justin Trudeau fit resign, why? – BBC


Canadian Prime Minister Justin Trudeau speaks during plenary session of the 9th Summit of the Americas in Los Angeles, California, June 10, 2022

Wia dis foto come from, Getty Images

Canadian Prime Minister Justin Trudeau fit announce say im wan step down, though e neva make up im mind finish, tori pipo Reuters dey report.

Reuters say di sources wey tok to am on Sunday afta one of Canada top tori pipo Globe and Mail bin first announce say, Trudeau dey expected to announce as early as Monday say im dey resign as leader of Canada ruling Liberal Party afta nine years for office.

If Trudeau resign, e go leave di party without permanent head for period wey polls dey show say di Liberals go badly lose to di official opposition Conservatives for di election wey must o happun by late October.

Di sources tell Globe and Mail say dem no sabi exactly wen Trudeau go announce im plans to leave but say dem expect am to happun before one emergency meeting of Liberal legislators on Wednesday.

Many Liberal members of parliament wey don dey worry about di different negative results for polls, don tell Trudeau for public say make im resign.

E neva clear weda Trudeau go go immediately abi im go remain PM until Liberal select new leader, Globe and Mail report add.

Calls to resign grow

Trudeau become Liberal leader for 2013 wen di party bin dey inside big gbege wey land am for number three position for di House of Commons for di first time.

If im resign, e fit lead to fresh calls for quick election to maintain stable goment wey go fit deal wit di President-elect Donald Trump goment for di next four years.

Tori be say di prime minister don discuss wit Finance Minister Dominic LeBlanc wed aim go wan become interim leader and prime minister. But di newspaper say dis plan no go work if LeBlanc wan run for di leadership position.

Trudeau, 53, bin manage silence Liberal MPs worry about bad polls and di safe seats wey dem loss for two special elections.

But calls for am to step aside don grow since December wen im bin try to demote Finance Minister Chrystia Freeland, one of im closest cabinet allies, afta she push back against im proposals for more spending.

Freeland resign instead, come write letter accusing Trudeau of “political gimmicks” instead of to focus on wetin dey best for di kontri.

Trudeau lead Liberals to power for 2015 wit promise of “sunny ways” and progressive agenda wey go promote right of women plus fight climate change.

But dis no come be di case sake of many different reasons like di Covid pandemic, high cost of living plus immigration policy led to hundreds of thousands of arrivals.



This article was originally published by a www.bbc.com . Read the Original article here. .

Subscribe
Notify of
guest
0 Comments
Oldest
Newest Most Voted
Inline Feedbacks
View all comments